Di mystery of di $5m cash and fake gold wey no-one dey claim for Zambia Wia dis foto come from, Getty Images Article information Author, By Mike Thomson Role, BBC News One private plane wey dem find with more than $5m (£4m) in cash, fake gold, guns and ammunition on board dey at di centre of a deepening investigate for di Zambian capital, Lusaka. Everyone sabi di aircraft fly from di Egyptian capital, Cairo, and land a fortnight ago for Zambia, but dat na where di certainties stop.