'Dem rape me one afta di oda under di tree' Article information Author, By Mohamed Osman Role, BBC News Arabic As four paramilitary fighters for Sudan war-hit Dafur region dey gang rape Kolthom, na so dem dey abuse her sake of her race. Warning: Dis article contain details wey fit dey painful for some readers "Dem bin dey very brutal. Dem rape me one afta di oda under di tree, wia I bin dey gada wood to [make fire to] keep warm,"she tok as her voice dey shake inside phone.