To arrest Vladimir Putin for South Africa go be 'declaration of war', Ramaphosa tok Wia dis foto come from, Getty Images Article information Author, By Natasha Booty & Will Ross Role, BBC News Any attempt to arrest Vladimir Putin wen im visit South Africa go be declaration of war against Russia, di kontri president tok. Cyril Ramaphosa make di warning as e remain some weeks before one international meeting go happun for Johannesburg, to wey dem invite di Russian president.